PIDGIN: NA WHICH KIND DRESSING BE THIS!!!


 By: Mariam Busari 

Which kind dressing be this? No be another thing be this or I go talk say our mumu don too much;  na so your boot and bonnet dey show for outside as advert for people to see free of charge. Na me fuck up self or I go call am mistake. Oh, you be small budget cinema wey people fit use chicken change see wetin you get in stock?


Eh! Eh!! Eh!!! for you ehhh them dey hail you say you get front, you get back but I still dey reason am if you get sense o, my country people; no vex say my words dey somehow too harsh, strong and tanda for your face but this na ogbonge tory wey go make your life coole and he go pursue wahala and katakata comot for your domot. My sweet sister and big bros, he good say make you dey shine like sun but you yourself know say too much of everything is bad. Wetin be your gain if you dress and you take head with body resemble masquerade eh eh na so your dressing come be like ojuju calabar maka why na? u get the scope say no be say I come insult you o but u self need to think ham wella.

 


All the so so question wey I bin dey ask you requires answers not only answer o but he need make you self open your heart to the reality of life and ogbonge truth of life. 




My G!!! you be fine bobo but why

your dressing come resemble gentle man on the street, ahhba why you come carry your knicker for your yansh or trouser like say you shit for body. You come dey walk jagajaga for road all onto saey u wan do fashion. See yourself, a full grown adult like you, your mumu never reach? I nod my head and shook mouth for your matter o. if he pain you please take am easy and change from your bad ways.

Nigga, Big boy, Bobo, Sisi abi na which kind name ur padi yarn u, na true say money be fine bobo but of what of benefit be good house wey dey very pretty inside but na so so yamayama and dirty na him full the outside domot. Your food taste nice and if person chop am eh, na to bite our tongue and request more but na shame say the plate wey you want take serve the food is filled with sand and unwashed. Woos woobi, if I comot my eyes for the plate, my mind no fit get away from the matter o. you must be clean hmm  from inside and outside.

 


Oga madam, beautiful sisi, omoge campus, na your matter and tori get turn. No guy wey fit see you and him no go turn back to look twice because say if you sabi how to examine and keenly torchlight yourself, ah ah you are a queen. Nwa, you be fresh tomato naturally and originally made from heaven wey be our baba God but I con dey wonder the major factor wey land you to dress yamayama. You like rag pass cloth, eh!!! at that costly price, you go still patronize that kind cloth wey go expose all the secret and sacred places of your body. If I chook mouth on top the different types of pempe cloth wey this girl dey wear ehhh ooin English people call am provocative dress. These include crop top, mini and micro skirt, jumper, back off, off-shoulder and many more. On top this matter weyn I dey yarn you so, he go make sense if we cool our body and tourchlight on the point why bad bad dressing dey scatter all around the youths of nowadays. The number one thing wey I go yarn you na peer influence. Your friend do hairstyle wey resemble agama lizard head but shey you know if her career or profession connects with the mode of dressing she dey do.

 


On this kind leve, I no chook mouth if na yamayama or dirty work person dey do but I go clear you so on top better and good work wey dey legit. My friend dey Zag, him dey wear cloth like Jay Z and na that kind head you sama your brain say you want be like am. You want to feel among, get engaged and whatsup. Oh, no be say you no sabi or no dey updated o my bros and sis but the culture and our local life self no gree support such dressing. Hmm, I no say you dey feel me but shey you self sabi our media too don play hot role on the way them dey promote nudity and bad dressing. Better better program dey wey be say him go promote our entertainment show but na that one get the lowest coverage. But come to think say the ginger wey dey swagger for the ones wey them dey open body and part of our cleavages na that one people like to watch well well, support, fund and sama awoof money.


“You no sabi whats up, you dey boring, you no sabi content”, na so so bad mouth many people don put for some program wey no promote bad bad scenes or pornography. No be until we showcase and reveal our sacred part na him our beauty and glory or fame go come out. For this level so, he go make sense if there is strict and better guideline to reduce nudity as dem dey publish for people to see. If laws don dey for ground, make different agency sama big punishment for violations and make we orientate our people. Na the front horse the one wey dey for back dey look before him go pick race.

Another major thing for the way our people dey dress yamayama na the quest for civilization. Ehh, this one na big question for mama, papa, leaders, teachers and all members from the corner around agent of socialization. Na true be say he good make we progress as the world dey progress but how come be say we don drop our first lifestyle for water to carry away, we come embrace the alien way of life absurdly.

No be say I be enemy of socialization and civilization but he no make sense as we come carry am on our head other way round. On this factor so, our mentality don change patapata say if you wear some kind cloth, you be old school but if you come dress for kasala to burst, na hail dem go sama your head like say you won lottery. But I dey surprise say the kind perspective and the force wey the environment take back this concept of immodest dressing take make us be like if you no even get this wear self as adult or youth, you never be a fine bobo or cool sisi.

 


For me, I no say a wise pikin like you and I wey no go talk say my words bitter go reason with me with the small thing I don talk. But sha, make we sama tourchlight on how we go put an end to the menace. The adage be say na the way you dress go determine how people go reason your matter. If na cool or lowkey you dey go oh, you be original and gentle headed person as dressing matter is involved or you be fresher for campus or returning ones, this matter go comot bad eyes to join bad gang from your life. You don see ashawo wey dey wear modest cloth like a religious person go advertise him product for junction? You get name, your family get good name and I know say you self go want to protect and get better reputation wey no go spoil your image. If so, dress make them no say you no belong to them.

 

Make I no bore you with too much talk talk, all agents of socialization, religious with government must come have a proper re-orientation that will instill in us at our small age proper values. This hence go make or mar our thinking faculty and as the environment also needs to be convincing if we are to dress better.

Make you know say you be human being; dress like say you be person wey get future; you get name so bros and sis dress decently.

Comments

Popular posts from this blog

PUBLIC ADMINISTRATION HELD EXAMINATION BRIEFING FOR STUDENTS

ADEKANBI ADEYINKA OLUWAPELUMI EMERGES AS RHE NEW NAPADS PRESIDENT

PROJECT SUPERVISION ALLOCATION FOR HND 2 STUDENTS